Rivers pipo dey eagerly await di resumption of Governor Siminalayi Fubara after six months suspension
19 September 2025, 10:34 WAT
New Informate 5 minutes wey don pass
Di large crowd wey gada for Rivers State Govment House on Thursday in anticipation of di arrival of Govnor Siminalayi Fubara bin dey disappointed after e fail to resume.
President Bola Tinubu on Wednesday announce say di six months state of emergency e bin impose on Rivers State due to di political dia, go expire for midnight.
E direct Govrnor Fubara, im deputy, and members of di House of Assembly to resume dia official duties. While di House of Assembly bin resume, di state govnor never show.
Thousands of women, youths and supporters of di govnor bin dey celebrate for major streets of Port Harcourt as dem bin wait di govnor return in grand style on Thursday.

Di huge crowd cause heavy traffic jam across di oil rich city as dem march along di streets, dey sing and dance and celebrate di lifting of di emergency rule and restoration of democratic rule for di state.
Many of dem come di Govment House main entrance as early as 6:00am from different parts of di state, including rural areas, but dem begin leave in di afternoon, some of dem disappointed and dem no know why di govnor no come greet dem or resume work.
On Friday, some pipo don also dey di Port Harcourt International airport to receive am.

On di oda hand, di state lawmakers wey also bin dey suspended along with di govnor resume plenary on Thursday 18 September, 2025 for di conference hall for di Legislative quarters, Aba road, Port Harcourt.
Highlight of di plenary na a resolution to probe di finances and expenditure of di state under di Sole Administrator, Vice Admiral Ibok-ete Ibas.
Di lawmakers also ask Govnor Fubara to send di list of commissioner nominees for screening and forward an appropriation bill for consideration.
27 lawmakers na im resume plenary and di oda three wey reports say dey loyal to di govnor bin no dey among dem.
Dem adjourn sitting to Monday 22 September, 2025.
Meawnhile former Rivers State govnor and key player for di crisis wey lead to di declaration of a state of emergency for Rivers state, Nyesom Wike for one interview on Channels Television say legal obligation no dey for di govnor to resume immediately on di exact day wey di emergency rule end.
E say, “dia is no law wey say e must resume work today. Im be di govnor, I no understand di way we operate. Okay, dem swear me in today as di govnor for example, e no mean say I go go di office tomorrow.
You no know wetin my programmes be, you no know wetin di govnor don schedule to do, you no know wia im dey,” e tok on top di mata.

